Tuesday, December 16, 2008

Naija police,una no try!

I do decide 2day say I go write  dis post 4 pidgin,sake of say our elders bin talk say "e na gud to  dey wash our doty pata for public" and like my Granmama dey talk "watin u na fit talk for public,na talk am fro general". Our police na dey try! Na 4 naija I c say police go giv info way person giv dem to d person way commit crime fro sake of Kola.
 Na so one security man for area take go yonder without return ticket.sake of say im no do Aba boiz style(shap-shap burning) after im catch thief.He handova d thief to police insted way dem MIB go do their work,dem release d guy after enuf pepper don rest.D guy com go regroup,raid the same area,dem catch d security man beat am like die,use knife do am watin mai suya dey do suya,befor dem com finally kill am by shooting!
Tell me how I go take listen to Oga Okiro if im dey sing im "helep police wit info" song for TV & radio? Watin go come happen to the man wife and small children? Dem get mouth tell us say dem dey do investigate for matter way don spoil.E dey pain me even as I dey write am so.May God helep us and helep our ''money-concious OLOPAS", AMEEEEE

No comments:

Post a Comment